Wednesday, February 17, 2016

SEE LEVELZ...DEM GIVE YEWANDE VIP FLEXING WHEN SHE SHOW FOR COURT


28-year-old Yewande Oyediran (nee Fatoki), the lawyer for Oyo State Ministry of Justice who dey court say she kpain her 38 years old husband, Oyelowo Oyediran, show face again yesterday before Magistrate Kehinde Durusaro for Oyo state Magistrate Court 1, Iyaganku, Ibadan on Tuesday with plenty security plus say dem dey give am VIP treatment. Tori say na different bus dem take carry Yewande come, the Agodi Prisons Ambulance with number PS 638 A01 plus prison pick up as escort while dem bring other pipu wey no get surname for  inmates Prison Black Maria and those ones dey shout tell press pipu say na BCOS of her dem come late to court O. See levels. 

Dem cover her face enter court ni with 8 prison officers wey Capito cos dem no want make press pipu snap her pinshure. Wen dem call her mata,  police Lawyer, Inspector Adewale yarn the court say advice from the state Directorate of Public Prosecution don ready. 

Yewande Lawyer, Mr. Seun Abimbola, who carry 6 other lawyers follow body say dem no know say the DPP advice don ready O,  so Magistrate push the Mata go March 1, 2016 for mention. But Lawyer to the persin wey die say the court no even get power to hear the Mata. He say he no even Sabi who dey court cos he no Sabi who dey under the cloth,  say dis kain thing no dey under we Law,  say dem don dey too protect her O. 

No comments: