Wednesday, February 17, 2016

WE NO TALK SAY WE WAN DEY BURST KASALA O, IPOB POLONGO


The Indigenous People of Biafra, IPOB, don talk say na lie O,  dem no talk am say dem go dey burst kasala with we security pipu who don dey kpain dem members wen dem dey do Aluta and dey pray. For one statement wey dem throway yesterday by dem megaphone, Mr. Emma Powerful, say dem never talk dat kain thing even as dem wan make dem release dem Oga who still be director for Radio Biafra, Mr. Nnamdi Kanu and say make dem free dem country,  Biafra. He say na lie dem dey lie for dem head o,  dem he just want make pipu dey see dem like bad pipu ni. 

He say afta dem kpain some of dem members for ABC, Abia State dem talk say dem go dey defend demself, but dem no talk say dem wan dey use weapon. He say but e dey funny am sha O,  say pipu wey dey kpain dem since come dey fear bcos dem talk say dem wan dey defend demself,  he say so dem no wan die. He say make dem try kpain dem members again,  na den dem go see as dem go defend demself. 

No comments: