Wednesday, February 17, 2016

SEE GBEGE O, 5 FACTORY WORKERS THIEF 2.8 MILLION NAIRA PONMO

5 pipu wey dey work for factory on Tuesday, din shout say na lie dem no thief ponmo. Tori talk say dem thief ponmo wey him price be Dat kain N2.8 million wey belong to Rainbow Network Limite. Dem be three security guards; Nathaniel Ojo, 33; Olokwu Daniel, 30; plus Jude Thomas, 25. Others na Richard Daniel, 36, and Micheal Adejo, 23 wey dey work for the company. The company, Rainbow Network Limited na him dey do poems and na dem manager, Mr Gbenga Ayodele, see say some Ponmo sack dey miss for the warehouse.

After dem shine light for the mata, the company sacked Thomas, who be the security guard on duty the day dem thief the pond,  den for 1am for night dem see 5 of dem dey try move the pond from where dem hide am na him the security man on duty begin shout, we dem show dem face for court dem say na lie dem no do bad. The Chief Magistrate, Mrs Taiwo Akanni, come give dem bail for N250, 000 each with two sureties each in like sum, come push the Mata go March 9, for mention.

No comments: