Wednesday, February 17, 2016

NA WA O...TRAIN KPAIN DEAF PLUS DUMB GRADUATE FOR LASGIDI


Train don kpain one graduate wey no fit talk,  no fit hear for Oyinbo area for Lasgidi. Tori yarn us say the guy dey Waka for railway line around 2 in the afternoon on Tuesday when the train wey he just begin Waka from iddo go jam am die. pipu wey dey the area so all wetin dem do to signal the guy no work cos he no dey hear,  na so the train take cut the guy into two. 

Tori say the guy just pray finish for mosque ni before the bad thing shele and e no too tey wey one of him family kpain O and dem come dey beg government to come do something to Dat kain train accident wey dey always kpain pipu for that area. 

No comments: