God just bless some pipu like dat, na so e be for Ubulu-Uku community wey dey Aniocha South local government area for Delta State wey carry dem crown sama one 15year old pikin, wey be the pikin of dem before before King, Obi Ofulue lll wey some fulani malu pipu kidnap come kpain some 45 days ago. The new king na15- year old secondary school guy and him name na Obim [Agbogidi] Chukwuka Noah Akaeze I. Wen dem dey do the parry, the Palace Secretary, Joseph Obaze, said the thing follow dem tradition say the pikin of dem king wey kpain become dem new king. We say congratulobia to the New King.
No comments:
Post a Comment