Friday, February 19, 2016

CRIS NIGERIAN DON POLONGO SAY NO BE HIM DIE O

Minister of Labour and Employment, Dr Cris Nigerian din polongo say him still dey stand well well O. Dis one na as one 50 somtin year old man fall and kpain for House of Representatives Area of we National Assembly. Na one on tori polongo say na Senator Chris Nigerian be the person when he defend budget for National Assembly. Na so Bros go climb Facebook go polongo say na lie O. Tori say dem never sabi the person wey die around Dat kain 10 in the morning. Dem say na for front of the office of Chairman, House Committee on Police Affairs na him he fall and wen dem go rush am reach hospital dem say he don cross Jordan and him family just jejely carry am go Arch go bury as per say him na Muslim. So Ngige say no be him die O.

No comments: