President Muhammadu Buhari, yesterday don continue with the letter wey he dey share o, pipu wey collect dis time na Director-General for Budget, Mr Yaya Gusau, and polongo a Mr. Tijjani Abdullahi as him replacement and dem appoint Mr. Ben Ahabue, Special Adviser to Presido on top National Planning. President Buhari still appoint former House of Rep member, Mrs Abike Dabiri-Erewa as him Senior Special Assistant on top Foreign Affairs and the Diaspora.
Presido also, yesterday, approved say make dem collect job from 26 Oga for some federal parastatals, agencies plus commissions. Secretary to we federal Government, Babachir Lawal for one statement, say pipu wey collect letter na Oga of head of NTA; Mr. Sola Omole; Oga of FRCN, VON, NAN, NBC, PTDF, NEPAD, NSITF and like dat like dat

No comments:
Post a Comment