The Kwara State Governor, Alhaji Abdulfatah Ahmed, on Monday said some workers for the state dey collect plenty salary. He say na dis yeye thing make local government plus the State Universal Basic Education Board no fit pay salary wen dem suppose pay.
He say government don dey collabo with banks to dey use BVN to catch pipu wey dey collect pass one salary. Ahmed yarn for one kain stakeholders’ meeting with dem APC Padis for Ilorin. The governor even talk say the state government go do screening for civil servants, basic level teachers, local government workers plus pensioners to commot ghost workers for the state.

No comments:
Post a Comment