EFCC don on Monday show face of the Oga Provost for the Federal School of Medical Laboratory Technology, Dr. Nkereuwem Etukudo, on top say he do jibiti, chop money, come still kolobi plenty money wey dey go like millions of naira. Dem still show face of 2 other staff of the school plus 2 other contractors, dem be Accountant/Bursar, Mr. Yusuf Samuel; the Data Analyst, Mr. Ernest Demto; plus Messrs Esio Udoh and Goodluck, wey be contractors.
Dem show dem face before Justice Y.D. Dakwak for Court 2 inside Jos High Court. The mata no fit go on sha cos government lawyer, Mr. Steve Odiase, yarn the court say the Mata no go fit go on bcos one of the accused persons, Ernest Demto get kidney disease and he dey collect treatment for the National Hospital, Abuja.
He say e no go make sense if dem continue the Mata without him, so dem beg the court make dem give dem anoda date to come back. He even say make dem dey pray make God sharperly heal persin wey dey sick O, say by next time if the guy never well dem go continue. Justice Dakwak answer him prayer sha when he push the Mata forward to May 2.

No comments:
Post a Comment