Police for Ondo State don catch one guy, wey dey form craze for Akure on Monday and dem find 18 ATM cards for him hand wey be from different banks plus some cash for him hand. tori yarn us say na Ijapo area, some pipu for catch am before dem come carry am give Police for Ijapo Police Station.
The pipu say dem suspect am say he be him armed robber wey dey form craze. Tori say no be today wey the pipu don dey put eye for him body cos of him kuru-kere Waka. Na dis Monday dem come challenge am and all his explanation no make sense. Na so dem catch am carry am go give police. Tori say dem find plenty different kain money wey him no fit explain where he for see am for him hand. Na all this things make dem believe say the guy no be real craze man. Dem still see some jewellery plus neat clothes inside the bag wey he dey carry. The Police megaphone for Ondo, Mr. Femi Joseph, say dem go carry the guy go hospital Cho check him brain maybe na true he dey craze.

No comments:
Post a Comment