Tuesday, February 16, 2016

SEE LEVELZ AS NAJATU MUHAMMAD REJECT FEDERAL GOVERNMENT APPOINTMENT


One woman wey be activist plus politician, Najatu Muhammad, don take levels reject appointment wey dem sama her as the chairmo for the Governing Council of the Federal University, Dutse. Muhammad, who everybody sabi as padi of we Presido wife, Aishat Buhari, na him show the levels on top newspaper where she talk the thing wey really pain her for the mata na say dem no even yarn her anything before dem go polongo her name for inside newspaper. 

Make e no come like say she no get respect, she first thamk dem for say dem think say she fit do dat kain work but she no like am at all say dem no even yarn am before time, as e come be like dat, she no get option pass make she too yarn dem her mind on top newspaper, but dat one no mean say she no support sai Baba again o, especially as he dey was corruption commot from naija. Na she first do dis kain thing for baba Buhari government.

No comments: