Monday, February 22, 2016

BUY A BOOK, SAVE A LIFE... MISTER RAIN SHARE BOOK FOR ST'ANNES MOLETE FOR HIM BYDAY

One of we OAP's wey still be Comedian, Babatunde Ojobaro dey celebrate him byday today,  Feb 22. And as part of the celebration things he go share some books for school children for ST'Annes School wey dey Molete, Ibadan. The level na part of him buy A Book, Save A Life project wey he don start for some time now. Press pipu from Space FM dey there come cover the level, and some of him radio Padis like; ATM (Space Fm), Afouda (Lagelu FM), Femi German (Naija Fm)  plus others and for sure him babe wey dem marry last year December follow dey. The byday boy say na him own way of celebrating him byday be Dat.  We for TPN say happy byday to our padi for Radio.

No comments: