Wednesday, February 17, 2016

DASUKI WAN DODGE COURT COS OF PLENTY BAD THINGS WE HE DO NAIJA

We Federal Government for Naija don accuse the former Oga NSA, Sambo Dasuki, say he dey try Dodge him mata for court cos he no wan make country pipu Sabi the plenty bad bad things wey him don do. Na inside dem counter-affidavit wey dem submit for Federal High Court wey dey wey dem take dey beg court make he no reason am say he wan give Dasuki.

Dasuki dey yarn say make dem free am cos federal government no follow wetin court say make dem do, so make dem let am dey go free and say make nobody catch am again O. But when federal government go yarn dem say na lie O,  dem no disobey court on top bail mata O,  Dasuki just dey fear to go on with the Mata ni cos no want make Naija pipu Sabi the plenty bad things wey he don do. Government dey claim say na for another mata dem arrest Dasuki but Dasuki and him Lawyer, Daudu San dey argue say na lie, dem disobey the court ni and if court allow dem continue e go just be like say court dey support dem as dem dey disrespect am. Na later dem come beg the court make he give den time to take respond to wetin government dey yarn,  Na so Justice Ademola wey dey Seddon on top the Mata answer dem even as government Lawyer no wan gree, he say make dem come back on March 3 for the Mata to continue. 

No comments: