Wednesday, February 17, 2016

O BOY EH! WOMAN BORN 5 PIKIN TOGETHER FOR IBADAN


Chai... One 28-year old woman, Sakirat Rasaq, don born 5 pikin at the same time O,  she born three boys plus two girls for the University College Hospital, Ibadan on Monday.  Dem Papa, Alfa Yusuf Ewenje, 32, said him na full time Alfa and na from Adeoyo Hospital dem send dem go UCH.

He say na when the belle enter 3 month,  na him scan show dem say no be small Mata o, He say na 8.45am on Monday the babies land and dem stand well well. Dem bin din get 2 children before and na Ijokodo Ared dem dey sty for Ibadan. He say wetin dey ground now don plenty pass him power O,  anybody wey get plenty make dem come help am O. 

No comments: