Wednesday, February 17, 2016

56 YEAR OLD PAPA CHUKE PERSON WITH BROKEN BOTTLE ON TOP ARGUMENT

Dem don accuse one 56-year-old man, Babatunde Ishola say he chuke him neighbor with broken bottle for Anuoluwapo Street, Shomolu, where dem first dey argue before dem start fight. The person wey he chuke na George Friday. According to the police, Babatunde chuke George for head and dem say the offence dey against we Law under the Criminal Law of Lagos State of Nigeria 2011.

For the court wey dey Yaba Magisterial district, Babatunde beg say he no dey guilty O and dem give am bail for N200,000 but say make he go dey prison till he finish him bail mata. The Magistrate, Mrs E. N. johnson push the Mata go March 24, for mention.

No comments: