Sunday, February 28, 2016

LAIDE BAKARE RELEASE NEW PINSHURE TO YARN US SAY SHE STILL DEY HOT

MISS SIMPLICITY -
For d new foto wey laide bakare sama media to take promote her new film "Hally The Drummer" d actress show sey she still dey hot. "Hally The Drummer na d story of one girl wey dey sell agbo(herb) 4 street nd pipu dey call her "Sis Alagbo" wey e be sey she get many talent.She fit dance, sing nd she fit play drum wey dey tok. One of her talent make her get many money wey e be sey she com dey travel from one country to anoda bt she com spoil every tin wey she let money nta her head nd make her forget d beta family wey she for come. D film feature top nollywood actors nd actress like Kunle Afod, Eniola Badmus, Doris Simeon, Regina Chukwu nd many more. Dem shoot d film for Nigeria nd London nd na Simline Int'l Production naim write, direct nd produce d movie....Make una dey expect d film....

No comments: