Friday, February 19, 2016

PLENTY LIONS ESCAPE FROM PARK, ENTER TOWN FOR NAIROBI, KENYA

Some kain lions don escape from one park we dey Nairobi, capital of Kenya and na him make everybody for the area dey fear for dem life and pipu wey dey work for the park don enter town dey find dem. Wetin make am be as e get be say,  dem officials no even sabi how many dem be wey waka early momo today. Na for twitter dem first polongo say na, 6 lions don stroll go where pipu dey stay but when the park megaphone go yarn he say dem no really sabi how many dem be o, say na pipu dem dey expect make dem clear dem whenever dem see any of the Lions.

No comments: