Friday, February 26, 2016

COME SEE CRY AS DEM BURY BABALOJA FOR ALESHINLOYE MARKET TODAY FOR IBADAN

Many pipu dey cry as dem dey bury am today, even one of him pikin wey dem dey call Abiola talk sey d alhaji na beta man wen him dey alive, he confirm am say d man no dey like wahala wen he dey alive....na two of abiola pikin wen dem dey call usman nd yusuf naim baff d baba Loja before them bury ham. Some important pple wey show for the burial,  na pipu like Mrs Ajimobi, the step- mother of the Oyo state governor and the iya Loja of the whole Ibadan Chief Labake Lawal.
Tori wey reach our hand tok sey the iya Loja of aleshinloye don die few month back nd dem Neva bury her before d baba Loja sef com join her.
We for TPN dey pray sey make God protect d family wey him leave behind ooooo.

No comments: