The court wey high-pass for Naija wey everybody Sabi as Supreme Court don give confirmento say make dem go kpain the General-Overseer for Christian Praying Assembly, Chukwuemeka Ezeugo, wey everybody sabi as Rev. King, dem say make dem go hang am die ni. Na today the 7 judges wey dey Siddon for the court, wey Justice Walter Onnoghen dey be dem Oga yarn dat. Make we no forget say na since January 11, 2007 dem court don first talk say make dem go kpain am on top say he kpain one of him church members, Ann Uzoh. Toor.... GOOD NIGHT Rev. King.

No comments:
Post a Comment