Wednesday, October 14, 2015

WE SENATORS TRY FALL FAYEMI HAND BUT HE TOO MUSH FOR DEM

Trust my Naija pipu dem like to dey famz beta thing. Na so dem climb twitter yeaterday dey famz Kayode Fayemi, wey be Gomina for Ekiti State before. As Fayemi show for we senate house, na so dem wan take yeye questions fall him hand, but the bros no shake, he just stand gidigba dey finish dem one by one. The way he talk and answer dem questions, na him he take trip Naija pipu wey dey hail am on social media say he too mush. See as God dey work o, dem bin wan fall him hand but God pass dem come take am make the guy shine. Dem still dey continue the screening today o...so the drama never end.

No comments: