Wednesday, October 14, 2015

KAYODE BELLO SAY HE NO GO GREE O, HE GO WRITE PETITION AGAINST PROF. ADEWOLE FOR MINISTER

If you go UI for time wey no too tey, e no get how you no go sabi K-BELLO, the guy na Law student dat year, still be journalist for campus but him real name na Trouble maker. He like wahala pass water. The guy get plenty wahala with UI authority as he say dem no gree make he go Law School, dem no wan make he serve plus plenty issues. Maybe na all dis tins ge reason wey make am say him go write petition give Senate say make dem no gree allow the oga patapata for UI, Prof. Issac Adewole become minister o. As he talk am, na so so laff pipu dey laff am but me i know say the guy go write the petition maybe dem go come reason am for senate na him i no know. Make we see down dey watch the season 2 of IFA VS KAY BELLO.

No comments: