If you like Baba God abi you like gospel music very well na good news I carry come give you o, cos dis Sunday go bubble for Ibadan bcos David O. David don vex finish to do him concert wey he call FIRE PRAISE AND THE PROPHETIC this Sunday wey be 25th of October for La Chateau wey dey Housing Roundabout for Bodija. Na David O. go dey lead plenty other gospel musicians wey go come lead all of us go front of Baba God. Pipu wey go dey there na pipu like Big Bolaji, Yetunde Are, Ibironke Adeniji, Dare Anoda Level, Tee Dreads, Babatunmise, Bois Olorun plus plenty other pipu. Na 2pm the mata go start and dem no dey collect gate fee. If you dey find me on Sunday na there I go dey. #lol
No comments:
Post a Comment