Comedian wey popular pass for Ibadan wey don still add Radio work join him handiwork abi na mouthwork don ready to make UI students laff throway body dis saturday with that hin tush comedy show wey he dey call Comedy Hub, na for UI Arts Theatre he wan do am, money wey una go take enter na 500 Naira pere. No be only Peteru go totori Uites o, him goons wey he carry join body Mister Rain, Dr. Frick, Mc Olympia, Fabulous Pizzy plus some other beta artistes wey dey rock Ibadan. And of course Beat Fm plus Naija Fm where he for dey work dey support am. So UItes make una no dull o, 5h na small money. We go dey expect una.
No comments:
Post a Comment