As e come be say ba we beta pipu dem born plenty for this month, the byday neva finish cos na double today for the house of my padi wey be comedian plus business man, as he dey make pipu laff, na so he dey sell game, sell phone, sell anything sellable. Professor Apple wey be the comedian wey black pass for Ibadan, I no too sure who black pass between him and Seyi Law sha, na today October 23rd be him byday and no be only him, na him and him first born Goodluck dey do byday together today, na early this month make una no forget say na him he born number 2. So we say congratulobia to Professor Apple and him family.

No comments:
Post a Comment