Friday, October 23, 2015

NO BE SMALL MATA O, KAY BELLO DON SUBMIT HIM PETITION AGAINST U.I. VC PROF. ISSAC ADEWOLE

Some pipu get mind sha, when Kayode Bello wey everybody for UI sabi as K-Bello talk am say him go write petition against how dem take nominate UI oga patapata wey go soon commot, Prof. ISAAC Adewole, everybody think say ba just mouth. Pipu wey sabi K-Bello well sabi say if the guy dey fight he no dey see caution, so we know say he go do am, and now he don do am. He don carry petition go nack for Senate Presido office say Prof. Adewole no be beta persin wey suppose become Minister for Naija, when he carry the mata put for facebook, he even talk am say he ready to testify against IFA if dem call am for senate. Trust Naija pipu na as many pipu dey hail am, dey beg for the full copy, na so some dey swear for am. He even say some other Profeasors too don submit dem own petition. So make we siddon dey look wetin go shele nextweek wey dem go screen Adewole hopefully.

No comments: