Friday, October 23, 2015

FIRST CHRISTIAN OPERA CONCERT FOR NAIJA GO SHELE DIS SUNDAY FOR IBADAN

Wow.....me bin dey think say na only oyinbo pipu dey do dis kain tin, but na lie o. The mata go shele dis week for we own dommot here for Ibadan and if you sabi wetin good for you, na to come see am for yourself. The mata go shele dis Sunday, the 25th of October for Greatest Love Church wey dey Akobo for Olopa busstop. Dem call am UNVEILING IMAGINATION and na The Imagination crew dey make am shele, pipu wey go do guest appearance for there na Ibironke Adeniji, Tommy Tush, Joshua Ise Orin, Turbaskey, some beta music group plus Afouda go gather dey there. I just wan see how the mata go be...you nko?

No comments: