Wednesday, October 14, 2015

KERE O...OYO STATE POLICE SAY MAKE OKADA NO DEY CARRY 2 PIPU AGAIN O

I no know maybe make I call dis one good news ni abi bad news cos na yesterday Police for Oyo State dey polongo say dem go start to dey catch okada pipu wey dey carry pass one passanger from today. Na the megaphone for Oyo State Police, Adekunle Ajisebutu polongo like dat yesterday for inside one statement, dem say na because of pipu wey dey take okada do criminal tinz. So if you dey stay for area where okada for dey carry 2, make una dey get ready to dey pay double money cos I trust Okada pipu, na increase dem go increase okada money to take balance up. Meanwhile all those yeye Union pipu wey dey enter road anyhow for Adamasingba area plus other places make police try do something about them too. Abi no be so, make we do am 1:1 goaless draw.

No comments: