Wednesday, October 14, 2015
ALAKOWE BUS DON READY TO START WORK ON MONDAY O
For those of una wey dey ibadan plus including Lagos, the good news be say Alakowe Bus don ready to start work on Monday, dem say na 1500 pere dem go take dey carry pipu go Lasgidi from Ibadan same same if you dey come back and AC go dey blow your life inside the bus, you go watch DVD, you go still siddon like village chief. The one wey come totori me pass be say una go chew something, everything for inside 1500. So whether hold up day abi he no dey for redemption camp e no go concern you, in fact make e dey na him go pay you pass, so you go get chance take finish one full indian film. Abi no be so?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment