Kere o! I hear say football match wey go tough pass for this year go shele tomorrow o, for inside the dommot of Yinka Aiyefele incorporated cos na members of 2 of Aiyefele company wan show dem self pepper tomorrow for field. Na Merry Makers vs Fresh Fm presenters. So make you dey listen to dem cos as i listen reach dem no talk venue. Make we come see dem Dj Flexxy, Alhaji Abolade Salami, Bayo Faleke, Dj Nuu, Rolake play against pipu like osan, ege cassava. Life sha, shebi na Yatti for wear captain band for merry makers tomorrow if to say he still dey ni. But life go on and the match go tuff die as dem don dey make mouth gan. Lol......make ambulance sha dey on standby for injury sake. Lol.

No comments:
Post a Comment