If you be customer of Idea Consult. I say congratulobia. Even if you no be dem customer na still congratulobia cos next week na dem 22nd byday celebration and dem dey do collabo with Acer company wey dey do laptop to take sama beta pipu plenty awoof. So the koko be say if you get laptop wey still dey work, carry am go den new office wey dey for Osuntokun Avenue Bodija go collect tear rubber acer with chikini money. But dem say terms and conditions go apply sha o. But no dull am o, make you chop from dis awoof. Na so Engr. Wole Agbaje dem CEO plus Engineering Consultant yarn for the statement wey him release. Happy Anniversary o.

No comments:
Post a Comment