Mark 10:2-16
Some pharises run go meet jesus ask am, oga she hin dey inside law make man tell hin wife say 'I no do again' dem dey test jesus. Jesus con answer dem, wetin moses yarn una? Dem yarn back, moses gree na, hin gree make we write short note give our wife say 'we no do again'. Jesus con yarn say na be cos say una no fit sabi anything dat na y moses write d commandment for una. From d onset God make male n female dat na y man must leave hin pi-le and mi-le cabal, go attach hin sef to another wey der two go be com one. Wetin God Don sign, make no body troway d paper o. For inside room wey dem dey d disciples still ask jesus again, jesus con say, d man wey pursue hin wife go outside, find another woman marry am Don commit adultery, if na woman do d same na still Same offence. People begin bring pickin for jesus to touch, na hin d disciples dem begin pursue dem commot, but wen jesus sight d parole hin say 'make una leave this children make dem show my side, no stop dem cos na dem get heaven o. For I yarn una for low key anybody wey no welcome dis children no welcome heaven o,for anybody wey welcome dem, welcome heaven. Jesus con put hand for d children body con open shower of blessing voooooa !!! For der head. FROM THE PIDGIN BIBLE.. OB'S VERSION. NB: pls not for fun, as d Bible is written in so many languages in d world so also pidgin has bought a space to have its own version.. Share to ur loved ones. GOD BLESS YOU.
Sunday, October 11, 2015
WE BIBLE TORI FOR THIS WEEK FROM PIDGIN BIBLE BY OGINI BERNARD
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment