Tuesday, October 13, 2015
K1 SAY NA LIE, DEM NO SHOOT ANYBODY FOR HIM SHOW FOR AGO IWOYE
K1 de ultimate plus including pipu wey arrange the show for Limelight Hotels for Ago Iwoye dis last weekend don dey polongo o, say na lie be the rumour wey dey waka say some K1 boys shoot one student of Olabisi Onabanjo University, wey dem call him name Azeez Kofoworola wey dey Business Education department. Wen the Oga for Goldmyne wey arrange the show dey yarn, he say na lie o, na groove dem groove through out the show, the kabiyesi for Ago dey there, Governor Amosun send persin come represent am, plenty media houses like Hip Tv, Soundcity, Nigezie, City People dey there, plus including security pipu so him no sabi how or when dem take shoot anybody, say na dem enemies dey carry dat kain rumour, cos dem never see anybody talk say na true dem shoot am, na hear dem just dey hear. Wetin man no sabi na only God sabi, make God help us.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment