Monday, October 26, 2015

GOD DON READY TO CATCH TIJANI ADEWOLE, ONE OF THE POLICE WEY DEY SPOIL NAIJA POLICE

E be like say na time be dis wey we government for Naija go yarn us who be who and wetin dem dey do. Abo wetin concern fish with raincoat, wetin concern police with say car document, plate number abi driver license na fake. Na so dis Tijani Adewole wey dey work for CTU Owerri zone go harass one family with plenty excuses. The woman, Ifeoma Onwuka say na so the guy stop dem on dem way to Enugu yesterday morning, first say dem document na fake, wen dem no fall for dat one, he say dem plate number na fake, wen dat one too no work he hayaj dem say he go carry dem go him pbase for Owerri, dat one too no work, na so the badt guy go straight to the point say make dem roger am 50k as dem no gree na so he seize dem car keys detain dem for express for 3hours before saying make dem dey go without any kain explanation. According to the woman wey say the thing disturb her pikin, she say shey na like dis we go dey dey. Tijani Adewole don fumble and we dey expect dem police oga to treat him F up o. We dey expect.

No comments: