Monday, October 26, 2015

IBADAN NO DEY DULL, AGODI GARDEN SAY MAKE UNA COME GROOVE ON SATURDAY

Ibadan don dey bubble and we no dey dull again, as plenty beta place dey show na so pipu dey do beta things. Agodi Garden one of the beta places for we city dey call all of una make una come groove dis Saturday the 31st, dem say na the first time wey dem dey arrange dat kain tin be dis and dem call am "Groove At The Park" Na 6pm dem wan start am and dem get ticket. If you wan go, check dat dem art work wella you go see one number wey you fit halla. So no dull am o, go groove for small london inside Ibadan.

No comments: