Monday, October 26, 2015
NA ORITSEJAFOR KOBA GOODLUCK JONATHAN WITH HIM YEYE PROPHECY- OKOTIE
Na only God go fit help dis two bros solve dem wahala, cos he be like say dem no dey taya to dey gbege demself. Na so tori yarn TPN say when Chris Okotie dey preach for him church wey be Household of God church on sunday, he take Papa Ayo rob am no be small. He say Papa no dey try, na him carry him yeye prophecy take confuse the head of we before presido, Goodluck Jonathan. He say Uncle Jona no dey reason election again before, na Oritsejafor go yarn am say God don carry government dash am already make he just try carry step of faith ni, make he contest come see say God no dey lie, na so Jona go contest wey he take loose. He say some other pastors for CAN plus PFN dem sabi the koko, say na lie Oritsejafor dey lie but dem no wan yarn us the koko. But now he don talk am o and him no dey look Uche face. Lobatan.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment