I shock when someone talk am for my area say him no believe say dem Alfa Sule pipu dey go school o. Maybe na because say the way dem dey travel dey busy up and down. I no be part of dem but i sabi say e no go easy like dat make persin dey combine dat kain tin with school. Dat na why persin like AY, Woli Agba himself dey shout Alleluyah as he dey finish NYSC tomorrow. As he climb on top facebook go loud am, na so plenty pipu dey congratulate am say you do well broda, you don try. If you no dey go school bcos say you be rapper abi you be dancer, yeye dey smell for your body.
No comments:
Post a Comment