If you sabi Ogbeni wella wella go warn am o, make he no even reason am say na half salary him go pay for the month of march wey dem wan pay. The workers under the aburada of Osun State Joint Public Service Negotiating Council don throway one statement wey the Oga patapata of Nigeria Labour Congress, Mr. Jacob Adekomi plus the Chairmo for teachers, Mr. Wakeel Amudah sign.
For insde the statement dem say na falling hand o, becos no be wetin dem follow state government bargain be dat one. So make dem Governor yarn dem Accountant General for the state make he no try send dem half salary o. But sha wetin dem go do, if dem no answer dem dey for dem mind.

No comments:
Post a Comment