Lwkmd........Shebi dem dey talk am say one man food na him be another man poison, na him make Governors for naija wey dey under the aburada of APC dey yarn make every body hear o, say for dem o, dem no dey yarn the full world wetin dem get as property.
Na last week, President Buhari and him second calabash, Osinbajo yarn the full world wetin dem get as per cash and property cos na so dem promise wen dem dey do campaign. But sha dem Governors for APC say dem no dey declare o, cos we constitution no say dem must o declare am make the full world hear, so Buhari dey on him own on top dis level.

No comments:
Post a Comment