Saturday, September 12, 2015

PIPU WICKED O, DEM DON GO THROW BOMB AGAIN FOR YOLA IDP CAMP


Na wa o, dem badt guys don go throway bomb again for insde the camp of pipu wey don run commot from dem house cos of Boko Haram palava for Yola. According to wetin National Emergency Management Agency yarn on Friday, dem throw the bomb explosion for inside one school for Malkohi Camp wey dey Yola, Adamawa State.


The agency talk say na seven pipu kpain and na 20 pipu woundjure from the bomb wey dem throway around 10.50 in the morning. Dem still yarn us say dem don free 7 of the pipu wey woundjure as dem don treat dem for Federal Medical Centre for Yola and the rest 13 pipu wey include four NEMA officials still dey collect treatment for the hospital.

No comments: