Shebi me dey
always talk am say persin wey God no fit catch he never create am. Na so o, wen
Police for Ogun State polongo say dem don catch two badt guys; Demola David and
Dare Oladunjoye wey dey among the gang wey go take tipa tikuku chop the ogbono
of nurses and patients for Amazing Grace Hospital wey dey Ijebu Ode recently.
When the megafone of police for Ogun State, Muyiwa Adejobi dey yarn he say na persin do better aproko for dem wey police for Igbeba division for catch dem on saturday around 5:30 in the evening. He say na serious action film shele o cos dem just dey shoot like Rambo and commando but sha police strong pass dem and dem catch 8 of dem. Among them na him dem see the 2 wey rape and rob for ijebu-ode.
No comments:
Post a Comment