Monday, September 7, 2015

E BE LIKE SAY FOLAKE OTUYELU TOO DON RUN COMMOT FROM SPLASH O



Shebi if me I no see I no go talk. This one wey radio station just dey open for Ibadan anyhow, everybody just dey suspect everybody wey dem like for radio. Na him make some pipu wey like splash fm don dey fear say where dem darling Folake Otuyelu dey.


Na recently one of her fans, Ayodele Ibukun Sunday go write jamb question on top her facebook page, Folake Otuyelu. The fan say dem don miss her for radio o, say shey she still dey leave ni abi she too don waka go  join her padi for radio, Bayo faleke for Fresh Fm, say no mata wetin she decide dem dey her back like God.  But sha o, when Aunty Folake respond she say Una thank you for your love o, nothindg do me, all is well she say 

“Thanks for all your love, all is well. I will resume to……………..soonest. please
don’t ask me where, you will be informed!”
So make we siddon dey look o, maybe na for Splash, for Fresh ani another place, we go sabi for time wey no too tey.

No comments: