No be small mata o, shey na true say no body holy pass, even professors no too holy? I fear o, when I hear say some pipu wey dey among the 12 pipu wey reason am say dem too wan become oga pata pata for University of Ibadan no dey happy o, dem say dem no gbadun how dem do the parole. According to wetin dem write for one facebook page wey dem call CONSCIENCE POST, dem say one of the Professors no dey take am easy o.
He yarn say the way the mata dey go, the other pipu fit do aluta cos dem shock wen dem hear say dem polongo the persin wey win, Prof Idowu Olayinka, say the way dem run the package make dem suspect say he be like say mago mago don dey inside. Cos dem still dey wait , wen dem hear say dem don do press conference tell the full world as if say we presido for naija don gree make he be. nI even hear anoda tori say one of the professors wey dey vex don do one video wey dey on top youtube.

No comments:
Post a Comment