We carry 3 gbosa give we Senate Presido for Naija,
Dr. Bukola Saraki cos the Oga Senator on Friday don donate him pension wey he
dey collect as the before before Gomina of Kwara State give 2 Law student wey
sabi book pass for the Faculty of Law, University of Ilorin.
The two lucky guys na Tosin Mohammed plus including
Adam Ndakuku. When he dey carry the cheque of N500, 000 give dem under the
aburada of Abubakar Bukola Saraki Pension Scholarship Scheme to the guys, he
say him organization, ABSPSS go face students wey get bran but wey no get
money. We say Oga sai Bukky you do well.

No comments:
Post a Comment