Monday, September 28, 2015

SEE AS GOD DEY WORK O, NA 18 YEAR OLD BOY WIN MTN PROJECT FAME THIS YEAR

Na God sabi who be who, na so plenty pipu go mumu dem self for auditon all round Naija on top say dem wan win 5M, tear rubber jeep plus including record contract. Plenty pipu do audition, few enter the house, na 6 pipu come enter final parily parily. Na last weekend dem finish am and na Jefferey Akoh, 18 year old boy win the gbemu. He don join dem Iyanya, Chidimnma plus others wey don win before. I sha pray for am make he no be like one of those wey dey win no dey blow.

No comments: