
Monday, September 28, 2015
KUNLE AFOLAYN FILM, OCTOBER 1 DON STILL CHOP 3 BETTER AMAA AWARD
If something good, e no get any other pass say e good. Everybody don first sabi say Kunle Afolayan no dey do nonsense, all him films na fall and die. The last one wey he do, still dey hot like fire. October 1 na the film and pipu like Sadiq Daba, Aderupoko, Kunle himself kill the film wey get bete pinshure, the film clear die. After the film don chop all the awards wey dey Naija, e still go chop 3 awards for African Movie Academy Awards, wey dem dey call AMAA for South Africa. October 1 win award for Best Naija film, Best Costume Design and na Uncle Sadiq Daba win Award for Best Actor wey dey lead role. Dem say Kunle Afolayan happy die. If na you nko?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment