
Monday, September 28, 2015
ABEG, WHICH PARTY SARAKI DEY? COS PDP SAY DEM STAND GIDIGBA FOR HIM BACK
PDP say dem no fit follow Saraki chop, make dem follow am drink, make dem come run now wey the bros dey get surutul. Dem say If Saraki look back na dem he go see even before he see hin shadow sef. Dem say for dem o, the wahala wey dem dey follow Saraki drag no dey stand proper, e get K leg as per say politics dey inside. Wen dem dey sure say politics no dey dem go reason wetin dem dey do again. But for now dem no sabi one persin wey beta pass Saraki wey fit be our Senate Presido. Toor...my question now be say, abeg which party saraki dey?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment