Tuesday, September 15, 2015

POPULAR COMEDIAN, RAPINDADDY DON POLONGO SAY NA HIM BE THE POPE OF COMEDY

As e be like say na persin dey sama himself beta name wey him like for entertainment industry, Timaya dey call himself the Egberi papa 1 of Bayelsa, Gordons call himself Comedy Berlusconni, Oritse Femi dey call hinself Musical Taliban, ATM say na him be the Olubadan of comedy,Lafup dey call himself Bobagunwa of comedy. Na him make popular comedian wey dey stay for Ibadan, and wey pipu sabi as Mc Rapindaddy polongo last week Sunday say him too don sama hinself the title "Pope of comedy" He don even buy himself one long gold chain to show say no be small something. Congratulation o, to the Oga pope...hope you sabi say pope no dey marry sha?...Lol!

No comments: