
Tuesday, September 15, 2015
IBADAN NO DEY CARRY LAST...NA SO MC REMOTE GO LASGIDI GO WIN ALIBABA SPONTAENITY
Na God go punish Devil wey talk say we no sabi for Ibadan. Na so one of we beta pikin for this city wey dey make brain for comedy go for one kain big competition for Lagos, wey the Ogbonge comedian AliBaba dey arrange every 3 months. Na so we broda, Mc Remote, wey yarn dat popular funny joke ina o! ina naa ni! go the competition and as dem plenty reach from all over Naija wey come try dem power, na Remote dem crown winner for the level cos i hear say he pieces dem. Na so he take climb him facebook page: Tolulope Olayiwola go give Baba God double tuale for as he take win. Incase una no know say the last edition wey dem do before this one na still anoda badt guy from Ibadan win am, him name na Arole. Shey una come see say Ajisebioyo laari...na we be the pace setter, wey no dey carry last.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment