
Saturday, September 26, 2015
POLY IBADAN DON GREE MAKE UNA CHANGE COURSE O, IF YOU WAN WRITE DEM POST-UTME
Dem Oga patapata for Poly Ibadan don reason am to do beta for pipu wey wan enter dem school o, dem throway one statement where dem for yarn say dem don hear as many pipu dey complain say no be the course wey dem wan do gangan dem write for jamb form as per say wetin bin dey dem mind no dey dat time. But as things don change now, make e for no lost, anybody wey wan change him course get chance to do am now, sharperly sharperly. The courses wed dem list according to the statement na; Art & Design, Bus Admin, Estate Management, Building Technology, Quantity Surveying, Urban & Regional Planning plus including Mass Comm. Oya no dull yaself o.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment