Saturday, September 26, 2015

OREOFE WILLIAMS (AWO JESU) WAN DROP ALBUM TAKE CELEBRATE 8 YRS WEY BABA GOD CALL AM

8 year no be joke, dat na why Oreofe Williams wey everybody sabi with the name of him popular film Awo Jesu wan celebrate 8 of the halla wey Baba God halla am say make him dey do beta christian film with a different style. According to letter wey dem throw give TPN, the celebration go shele for dem dommot wey dem dey call City of Talents for Arapaja, Ibadan on top we independence day. The title of the Awo Jesu Manifestation Album as dem call am na MIMO and dem go even do seminar wey dem title; the message,the messenger and the money :Is it right to make money through gospel films? Pipu wey go yarn for there na Abel Martins ,Joke Muyiwa plus including the Oga patapata himself Oreofe Williams. Every every about registration dey on top www.oreofefilms.com. We say congratulobia boss.

No comments: